Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: No one at the atm stand is your friend
by
Mpamaegbu
on 18/07/2025, 13:47:13 UTC
...suddenly the elderly woman got an alert (debit alert) of about #400000 she screen! haven't said that another alert came again 250000 that was when the attention of the security personnel was called upon and they discovered that the atm card the woman was holding was not her card, her own real card was swap (exchange with the wrong card).
And somebodi will sey a guy like dat will die well? If tomorrow now people begin swell for dat dude at his burial as we dey do to Buhari now, dem go sey don't speak ill of d dead. How a young persin go defraud elderly persin? For those wey dey support Yahoo sey na Africans collecting back wetin Oyibo did to Africans during slavery, shey dat elderly woman na Oyibo?

Quote
Let’s be very careful while at the atm stand, not everybody seen at the atm machines want to widraw money some came for there fraudulent activities, don't call anybody to assist you except the security personnel working in the banks.
I nor even fit remember d last time wey I use ATM sef. If e nor far, e go don pass a year now sef. People nor too dey use am as online payments don dey rampant now.

Quote
Secondly, for our old parents we should not let them go to the bank alone, assuming that woman came with either her son or daughter that ugly incident wouldn't have occurred.
My dear, old people dey stubborn oh. Most of dem nor dey free sey dem nor sabi do anything. Dem dey always want to show u sey dem sabi pass u so dey won't look vulnerable, especially to u wey be dem pikin. Dem fit accept dat type of help outside but e go hard dem to admit am to their kids sey dem nor sabi am.

Again, and more importantly, old folks sabi act like dem nor get money. Dem nor go wan carry dem pikin go dat kain thing so no one go sabi how much wey dey dem kolo.