Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Topic OP
Bitcoin Na Still the Chairman for the Crypto Street
by
Joeboy
on 18/07/2025, 21:43:01 UTC
⭐ Merited by CryptopreneurBrainboss (1)
For this crypto space, Bitcoin na the only coin wey still stand gidigba. No be coin wey no dey follow hype or crowd, and today we go yan why Bitcoin na still the Oga on top for crypto, and why others still dey learn work.
1) Na Bitcoin wey Start the Movement: Before all this fancy coins wey we dey hear today, na Bitcoin first cryptocurrency to show face(for 2009). E bring the idea say people fit send money to each other without the need for bank or third party.

2) E Get Trust wey Others Never Build: Na Bitcoin wey institutions dey adopt now o, na Bitcoin wey countries dey legalize (like El Salvador in 2021 under the leadership of President Nayib Bukele), and na Bitcoin get the most secure and decentralized network. All this achievements no be by hype but by its strength, trust and track record.

3) For Naija People, Bitcoin Fit Be Better Escape Plan. Make we reason  this thing, Naira dey fall everyday like mango leaves, and people dey look for better investment wey Dem go keep their money. Bitcoin na better investment coz it protect the value of your investment, even if na small small you dey buy.

4) Bitcoin vs Altcoins The reality be say no be say altcoins no get value o, some actually get potential. But a whole lot of them na pump and dump or scam projects wey go disappear once bull run end. That is why it is unwise to o carry all your energy enter any altcoin wey you never understand. Start with Bitcoin and build from there.
Though  Bitcoin fit take time to build strong value wey go last long. But as my professor back then for school dey always talk, no be about speed, na about value.

Make I conclude with this-  For our newbies in the crypto space, if you dey em very serious and intentional about.wealth protection and financial freedom,  just know say Bitcoin na one of the surest road to achieve am.
But still no forget(Beginners take note):
👉 Always do your own research (DYOR). You can do this by belonging to a strong community wey Dem dey discuss real updates (like Bitcointalk), and also by reading articles and post from sites/ forum like cointelegraph, decrypt.co, altcointalk, and even this our our very bitcointalk.org
👉 No invest wetin you no fit lose or wetin no go make you sleep for night (This one dey very important)
👉 And you no necessarily need $10,000 before you go start Bitcoin acummulation, one very sweet thing about Bitcoin be say you fit start small, dey build your wealth.