Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Reason I prefer saving my money in exchange to Bank
by
Makus
on 19/07/2025, 08:30:00 UTC
...whether you do transaction or not they will charge you. Below is the reason I prefer saving in exchange to Bank
Na those old generation banks dey do all dat mumu stuff. I nor wan mention those idiots here. I nor dey see all dat wit Fintech banks dem. Instead na dem go dey give u daily interest if ur money dey for auto save. OPay and Palmpay dey give me joy. I neva experience am wit Kuda sha. Maybe na as I neva too dey use dat wan. I go try their features too.

Quote

...to be honest I feel relaxed and free whenever my money is in exchange because it very hard to get my seed phrase, pass key and the rest of them unlike Bank that someone can just penetrate without Bank sending you an OTP.
Nor too loose guard oh. Nor be betta advice to leave ur coins (I believe na im be d money) for exchange if you nor dey trade am. You fit keep am for ur private wallet and then transfer am to exchange only wen u wan exchange am to fiat and withdraw. But make we tell ourselves d truth, no how we go fit avoid banks completely. Wen u exchange d coin for exchange, na still through bank u go still take receive cash na. By then bank go don chop dem own commission.

Exactly and that na why me seff no dey too put body for all those commercials banks their thief too much i don't dey one day make them collect 5k for my account without me executing any transaction, I go make complain seff dem tell me say in the next 7 working days I go see my money, till today I never see  anything, that thing naim just make me abandon that bank. Except say I wan execute large transactions naim I dey use one of my bank else na fintech bank i dey use.

Taking about the use of exchange, exchange no be better place to save our money oo because for exchange no be you get full access over your coin, the exchange  wey you dey use fit decide to wake one day make them retrict your account  for no reason, na why we seff go still need to dey very careful when  we dey deal with exchange, just as the name implies, exchange,  just use am for that purpose  make you comot body.