Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Crypto No be Quick Money
by
Sammye3
on 19/07/2025, 15:11:50 UTC
Make we dey real most of us been hear about Crypto through success story for example-

- One guy wey buy one coin like this for 2020, don smash better profit as him be selling am today.

- One investor enter into meme coin and now he don dey drive GLK.

Na this kind story dey make many people most especially Money Driven Individuals  to jump into crypto currency with high hopes. Make I no lie I also be get high hopes when I been first enter crypto. And as the thing no con dey pay me initially, I con been dey reason to forget about crypto then jump into programming or any skill wey go dey reward the effort wey I been dey put in(So funny).

The truth of the matter be say Crypto no be magic money, if person carry that kind mindset enter am him fit jam better heart break. infact ehn no legit skill for this life be magic money, e go get times we you go encounter lose but e no mean say you go come give up.

📌Make we yarn small about the true reality of Cryptocurrency

1) Crypto price no dey respect anybody, no matter who you are. Today you fit buy a coin for $100, before tomorrow e fit just drop to $20, e no go ask for your opinion, just like dat it does it own thing, and if person no get mind, him fit quick tire.

2) Learn before you invest. As oyinbo man dey take talk am- Learning is a Process. Meaning that as human being we dey learn everyday. So you gats dabi wetin you de put your money into, if if not you are simply gambling with your money. Do your own research, no carry your last card buy one coin because one person talk say the coin go blow- you fit dey disappointed later on o.

3) Scammers choke for Crypto Space. WhatsApp or Telegram giveaways, or people wey talk say them go double your coin, avoid them like a plague, omo once you loose you money for crypto e don go be dat o, nobody go refund you.

4) Profit no dey certain. The reality of the matter be say no be all coins wey you buy go pay you, some go pump while some go dump, so always be prepared, have an open mind in case you experience any loss or profit

In conclusion, Cryptocurrency na better opportunity, but it can only favour people who are serious and dedicated to it, unserious fellowor people wey wan use am as a shortcut to wealth no dey last long for crypto.

No be lie you talk for here, if you carry that mindset of say na easy money making scheme you go fall short of your expectations. The matter no dey respect anybody true, even analysis no dey always work but you no suppose give up. Consistency and smart work na wetin  make man, even if you say make you dey try strategies you go just dey waste your time dey go. Sticking to one strategy, reduce your expectations and work smart.