Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Oh, please, someone should tell me this is a joke!
by
Liliana1304
on 19/07/2025, 18:06:24 UTC

The government know weytin dem dey do so? I just de wonder why these citizens go get high hope towards the Nigeria government? We know say na so so scam full their head. Weytin we go do to survive? We go just work smart and become independent because staying alive, one needs to fully understand the routes of this particular government, they indulge in social activities that will improve the country but will later make false promises that wouldn't add up.


No be today wey person don lose hope for the naija government and e dey pain me say even when we know say these individuals no get beta for us, during elections we go still rush sell our votes to them. I know say this plan nah another exaggerated means to make headlines and very soon nah audio go be the case for am.

We get so many issues wey dey trouble the country and the problem of insecurity don dey make am hard for foreign investors to come freely do their business here and instead of we government, if them no fit fix that one, why not use the funds do beta thing instead of this rubbish?