I understand say we all wan make sure say our money still maintain the value even as we dey keep am say make we use am do something, but make we try dey make sure say we no endanger the money wey we get sake of say we dey try protect the money value so that we fit use am for future do the things wey be say we been wan use am do.
Exchange no be sure place to do dat kain savings of your crypto dem sabi do Exchange dem strong things and if your funds dey dia, e fit move too, so in as much as say you wan make money maintain value, keep am for where you dey sure of which is non custodial wallet wey be say na u go dey in charge and dem no dey quick hack am so your funds go dey safe wey no be like exchanges wey dem fit hack.