I say make i bring this one up here make we follow put mouth
As a cryptocurrency person for naija, one of our major alternatives most especially for those of us from bitcointalk naija local boards, our major alternatives na either gambling or trading with bitcoin or other coins.
Aside from the fact that this two can give you possible high profits within a short period of time, both can still lead to major loses na why we advice make you do them with money you fit lose.
So how e be for you, using bitcoin or cryptocurrency to gamble and trade, as source of alternative income, as a Nigerian bitcointalk member?
Boss gambling no fit be source of income na wether na alternative or not, e no follow that one na just try ya luck, Trading on the other hand na Wetin you fit master then you go fit Control ya losses, I know say some people Dey see trading as an alternative, yeah this na people wey don master am no b just the common or ordinary man.
Anybody wey Dey see gambling as a source of income just Dey prepare to go down in finance (broke). Men Dey do am cos say dem wan just do to see if you go fit double or 3x… your money, and na fun for them, once you start to see am as a means of livelihood or alternative know say e don bad.
As a Bitcointalk member I been get interest for trading but I see say I go need to understand a lot of things to master am and the risk high…. I fit Dey practice other strategies wey b like trading but I nodey trade as a trader, betting and gambling na just for fun.