When I saw clips of the massive killings in Benue State by the Fulani herdsmen, I quickly had a flashback on a case involving a farmer called Jackson Sunday and a herdsman in Anambra State in 2015. Jackson Sunday in a bid to defend himself against a herdsman killed the herdsman in order to escape from the herdsman attack but recently on March 7th, 2025 he was sentence to death by hanging on the ground that he would have fled instead of trying to defend himself. This is a wrong judgement and a redicule to our judicial system. This judgement have raised contention in the legal and none legal environment.
Dis country matter just get as e be, if you no get connection for dis country, then make you know say you no get any right. Person wey get connection go Dey wrong, everybody go see say na him Dey wrong, but at the end, dem go talk say na d person wey Dey wrong Dey right, we just don Dey for country wey Dey messed up, I don’t know who go come help us for dis country self.
How person fight for him life, and him win you come still sentence d person say make dem kill am by hanging, if the government no fit protect us again, if we come Dey protect ourselves again, e don turn crime again, so e just Dey obvious say the government self the support all this Fulani herdsmen wey Dey kill people anyhow, because if dem no Dey support them, then Dey no suppose deliver dis kin judgement.