Well no be today wey people don dey talk about this exchange matter and believe me plenty persons for here sef get experience for this kind issue and most of us just don actually learn the hard way because I remember on so many occasions wen all these p2p vendors don almost wound me during the time wen I never too dey familiar with the whole thing.
And of all the exchanges I think this particular bybit exchange na be the worse because Omo the vendors for there just be like thief's wey dey wait for you to loose guard and then they pounce on your errors. I don even get experience wen person mistakenly pay for trade and then also cancel the trade by mistake but he later chat me and I release the entire coin for am.