Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Recovery cryptocurrency
by
SmartCharpa
on 22/07/2025, 02:35:37 UTC
When I hear say federal government recover some crypto from CBEX scammers the thing sweet because to collect money back from them no easy. The best thing to to do na make you no enter their trap. If you allow them scam you, to recover the money back no dey easy. Except the scammer do valid  KYC for the exchange to track the money no dey easy. But it's like the law enforcement agencies of advanced countries get some tools wey fit track transactions. But the koko bi say no allow them scam you.

You’re right, that one na the main issue, make person no allow scam enter at all, because once dem don scam you, to recover the money no be small thing, as dem dey always talk, "if no be your key, no be your coin." E mean say if you no get full control over your wallet, anything fit happen, some of these scammers sabi the game pass us, some of them sharp pass the people wey dey invest, na why we suppose dey very careful. Make we dey do better research, confirm things well before we put our money for anything because once money don enter wrong hand, e go hard to see am again.

However, even when government say dem recover money from CBEX people, we no still hear anything from them, nobody know whether dem return the money to people wey invest or whether na just whining. Me I been dey follow the matter, but till now, I never see anybody wey talk say dem don refund am. So na lesson be that, next time they will shine their eyes well and no let greed or fake promises push them enter trap.