Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Was unemployment part of your Bitcoin/crypto journey?
by
Mpamaegbu
on 22/07/2025, 13:05:16 UTC
... in this country, sometimes even the best of brains with a first class degree can find it difficult to secure a job. And not just any job, but a well-deserving one that can sort vital bills.
For Naija, na who u know go get u job nor be wetin u sabi. Na so dem dey talk am now. Dis, like I don talk before, na wetin make average people without passion for wetin dem dey do com full work places, especially for govment establishments.

Quote
He was constantly searching for a job up and down. Then one day, a mutual friend introduced him to crypto while he was waiting for NYSC. Since he was a bit tech-savvy, he decided to just give it a try. This was about 7 years ago though.
I dey talk am sey young people of dis era be d luckiest. Dem dey very lucky bc na d era of internet money we dey and social media com even help dem expand am well well by advertising so many earning opportunities. Those wey dey take up these opportunities dey really enjoy am. Those wey still dey doubt sey people dey live well based on genuine online runs go still dey look for eye and not make anything. Just imagine wetin content creators dem dey make or wetin those wey dey into crypto trading and investments dey make. You nor fit imagine d gap wit salary earners na. Haaba! D best thing na to put head for online stuff while u still dey school sef. Before u go graduate, ur hand go down find something meaningful doing.