Di four things wey you mention de very important for any community to get progress, before person go choose anyone if im get di opportunity to bring development for im community na to check di one wey dem de lack. Wetin one community get in abundance anoda one go de lack for di same thing. But assuming say my community de lack for dis four things wey you mention and I get di opportunity to choose only one of dem to execute as a project e go be between road and electricity.
Among dis my top two I believe say road project de more important pass because without road accessibility there is no how wey development go take enter di community. After road na electricity project because skills acquisition especially for digital skills and most jobs need electricity to de functional. Alternative sources de to get water, some communities get well to draw water, rivers and streams.
you talk well, but as you talk, weytin anoda community get another one no get, and weytin dey you important no go dey another person important. Na why i talk as make you look your community well, and take one project wey they reall need. I no say de four na essential things we all community supposed get, but na bad government dey cause all these debate.
So no pick two, just one we your community need most, you pick road and electricity, you don fail the test be that, just take one wey you fix do with 500m. As for me road dey my community na electricity i choose, wey if i install my community go happy die.