Make I no lie I no really been know about all this platforms dem wey OP don mention wey fit help children understand cryptocurrency and bitcoin, d way I dey c am sef e be like say some adults too dem go need go dis site dem go learn kne or two so dat b4 u go tell your pikin to use d site, you go need know wetin dem.dey go dey exposed to of e dey in line with wetin you want make dia mind start to dey know for age wey.be say dem don reach already.
No be everthing wey be say we know already so e no go bad to learn new things for dat side too as you dey try look to know wetin your pikin dem wan go know. E really dey good say make we dey expose our children dem to financial literacy early enough because dem go need am for future and if dem no learn am early, by that time.e dem go come dey behave like say dem be prodigal children pattern because dem go fit dey sue money anyhow.