Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Reason why many Nigerians never invest in crypto.
by
Donneski
on 24/07/2025, 16:31:52 UTC
I no gree for wetin the OP talk for here because me self na Nigerian so I know my people very well. The truth be say Nigerians are the most daring group of people you can see in any part of the world but e get big disadvantage wey we dey get and that's the fact that we no sabi take our time to study something and that's why many of us who knew about crypto in it's early stages been no invest that time — not because they didn't have the mental strength to take risk but they didn't know much and were reluctant enough to learn. Another thing wey kill naira people spirit for crypto be say people being dey use am scam many Nigerians even when the knowledge of crypto was limited then so plenty Nigerian people come think say crypto investment na something wey carry big risk wey go too difficult for person to invest and take profits at the end. Na when wey been know about crypto at it's early stages begin dey collect better profits and benefits wey some Nigerians begin put eyes for ground learn am well.