Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Reason why many Nigerians never invest in crypto.
by
Stable090
on 24/07/2025, 20:35:39 UTC
One reason wey i dun notice say dey make many Nigerians nor dey want invest for crypto na say we dey fear to loose money more than we dey enjoy to get am, so because say we nor wan loose, we dey plan am safe. How you see am? and what other reasons can we point out?
Make I no lie, one of the reasons why most youths for dis country no still Dey invest in bitcoin na just because of the economy. Even as person fit buy bitcoin with just little amount of money, but even d little amount of money no even Dey wey some people go use invest in the bitcoin, plenty people Dey dis country wey be say Dey no fit eat even twice convinently in a day, not to talk say make dem eat 3 times in a day. Person wey never get money wey dem go use eat, how d person go take invest in bitcoin, e no go really possible now.