Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Was unemployment part of your Bitcoin/crypto journey?
by
Stable090
on 24/07/2025, 22:40:06 UTC
When people are unemployed after graduation, it doesn’t necessarily mean they’re not fit to be employed, it’s just that, in this country, sometimes even the best of brains with a first class degree can find it difficult to secure a job. And not just any job, but a well-deserving one that can sort vital bills.
First class for dis country now no mean anything, I no even see difference between first class, and other lower classes wey remain, because even if you graduate with first class now, work no Dey ooo, only if you ready to work with private companies then you fit get luck, and if you Dey work with private companies, you self no go get peace of mind because dem fit commot you for work any moment, and payment fit no really Dey okay.

I don even see some companies wey Dey talk say dem prefer to higher HND holders, or degree holders with lower classes, dem say if dem collect first class holder, dem go Dey expect better money, so d money wey dem go use pay one first class holder, e better make dem use am pay like 2 ND holders.

Recently, I spoke with a friend who’s doing quite well in the crypto space now, and he told me that after he graduated, he didn’t have anything doing for about 7–8 months. He was constantly searching for a job up and down. Then one day, a mutual friend introduced him to crypto while he was waiting for NYSC. Since he was a bit tech-savvy, he decided to just give it a try.
Na before I graduate from school I join crypto space, I Dey 400 level that period, I been go for I.T I come see reality, I see say job no Dey outside make I look for how money go Dey enter, so na that period I come Dey hear about crypto trading, I come put head, because I sabi people wey don graduate for 5 years wey no get any serious work wey dem Dey do. I just seat Dey imagine say if I commot for school now make e no come be like say na house I go Dey stay, na so I start trading small small ooo. When I start to Dey trade, na borrow I Dey borrow money that time to trade, and I Dey lose am, na with time I come Dey understand how things be.