Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: No Wait for Change, Be the Change, Learn Digital Skills
by
casey15
on 25/07/2025, 06:54:17 UTC
I know say some of una don dey inside one job or the other, be it for this forum or even for one government job or  just even lap for one hustle just to cope with the economy. No doubt e dey okay, but make we dey truthful with ourselves, one stream of income no dey carry body again for this kind economy. Just as Burna Boy talk am- 🎶 Dangote Still dey find money 🎶 Meaning say even the richest still dey chase extra sources of income. Na facts.
That is why e dey very necessary for person to dey into one skill, prefarably a digital skill
Digital skills wey person fit enter include:

Cryptocurrency/ Blockchain Literacy, Graphics Design, Web Design/Development, UI/UX Design,  Data Analysis, Copywriting etc.

One sweet thing about this digital skill be say once you don sabi am, e go make you dey independent mentally and financially, you fit even dey earn your money remotely from anywhere in the world, no long leg or connections.

If you don dey into one skill already, more grease to your elbow! Just continue dey polish yourself, stay updated, and try explore new areas. But if you never start at all, this one na wake up call. Pick one. Start small. Learn am. Build am. Before you know, you don become boss for your lane. One love fam ❤️

Truly having multiple source of income is beneficial... One thing to take note is the value of the currency... When you earn in Naira and spend in Naira, not matter the number of sources, you will discover that things are quite expensive and that Naira will finish quickly... But when your income is in other currencies that has much buying value, spending in Naira will not really affect you.. this is were digital skill is powerful as it give opportunity for you to meet international clients and earn in foreign currencies....