Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Bitcoin will still make our dreams possible
by
Achalugo BTC
on 25/07/2025, 19:44:19 UTC

Dis one na d main tin for me, protect your coin and self from scammers and theft. Dis one nor be only thru online but our physical well being.  Tins dey happen we just need to be careful and do well to HODL our coin for like at least a decade make we see better ROI and people by date time go dey reason us as lucky people or with respect as how we dey reason others now.

Also, our health we need to dey careful make we nor go dey spend our profit for health matters. Make we and our loved ones dey careful follow healthy tips to live healthy as we grow older, God help us all.

Everything wey you talk so nah true, though person no dey  dey careful finish but e go good make we dey try our best to dey do things wey go favour us and not things wey go won put our own lives in danger.

Things dey really dey happen for this world wey we dey so, scammers dey increase on a daily basis, and na everyday wey some people dey fall victim, even that thing wey Dem dey advice them not to do, na that thing Dem dey do, and when them don scam them, them go dey need person wey go dey console them with advice, whereas na their fault.