The Red flags
... Some will even send you fake transaction receipts and fake testimonials from telegram users that never existed to in a sense lure u into believing in their tricks but it's all lies every time.
You see dis wan so, na im make me chook mouth for dis ogbenge matta bc e get anoda format wey get d same red flag like am but people dey always overlook am. Dem don take am scam so many people. The pattern na dis – Wen u dey wan run business wit somebodi and dem com tell u sey dem nor go fit cheat u bc dem bi pastor. My dear, run. Na dem. They just want make u loose guard so dem go fit enta u wella. If u nor wan run, make u calm down observe dem. A genuine pastor nor go use im mouth tell u sey im be pastor except na u first ask am.