I dey do my normal research before I come across this method wey dem dey call Dollar Cost Averaging (DCA), and I feel say e go really help beginners like me wey dey fear Bitcoin price wahala.
Wetin be DCA?
DCA just mean say you go dey buy small small Bitcoin steady like every week or month no matter how the price be. E no concern you if price go up or down, you go just dey buy your small piece dey go.
Example:
Instead make you wait to buy ₦100k Bitcoin once, you fit dey buy ₦10k every week. After some time, your average price go balance, and you go dey less worried about big dips.
Why I feel say DCA make sense:
1.E go help you avoid panic buying/selling
2.You no go dey guess market tops and bottoms
3. E go train you to dey save and invest small small
4.You no go lose everything at once if market drop
This one really dea good for people wey dey earn salary or get steady income. Even if price drop, you dey still buy am cheap and balance everything later.
References:
[1]
What is Dollar-Cost Averaging? – Investopedia