Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Reason why many Nigerians never invest in crypto.
by
Versatile_choice
on 27/07/2025, 20:36:44 UTC
Investing is not really a culture in Nigeria that we can say is not dominant in Nigeria. Formerly we fit dey blame say na the economy dey make many Nigerians nor fit dey consider investment as e require big money to take invest. As cryptocurrency dun show face, the opportunity to invest dey open for all, and e cun dey obvious say nor be just the economy dey worry us, but plenty other reasons.

One reason wey i dun notice say dey make many Nigerians nor dey want invest for crypto na say we dey fear to loose money more than we dey enjoy to get am, so because say we nor wan loose, we dey plan am safe. How you see am? and what other reasons can we point out?

You may be right when you said about fear" yeah, this one na the main reason why alot of Nigerians no dey think about crypto investment talk more of to just look into crypto Market just to see as in dey, you know say our Nigerians dey want Something way be say them get guarantee about the outcome, anything other than that them no dey gree put body na waiting make I no dey gree tell any body about bitcoin investment accept say the person just make up him mind to learn. and the economy too contribute to that because you no go dey espect person way be say him never see food chop to come dey do bitcoin investment so we gats reason am sha, but the truth be say those people way they interested go just invest regardless anything.