Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Bitcoin will still make our dreams possible
by
Princess Leah
on 28/07/2025, 13:11:48 UTC

I love to read about cryptocurrency now most of my social media feed is about Cryptocurrency, I was reading this post and I got the image from the post too yesterday https://www.instagram.com/p/DMfcPeHvLcj/?igsh=cjFieDgyNXhzM2po and according to the post they compared a ten years ago investment across super giants Google, Apple, Microsoft, Tesla, Nvidia and bitcoin’s return on investment after 10 years was $4.23 million only Nvidia tried coming close with $3.5million.

I have also been reading about dormant wallet making transactions after a long time and making ridiculous profits, the early bitcoin adopters are having profit overload but we are not late.

2035 is ten years from today and we pray make God give us long life, to Harvest big from bitcoin in ten years even with a tight capital na now we go need start.

If you fit
1. Dey discipline when spending
2. Find works wey you fit earn in bitcoin or convert to bitcoin
3. Learn to hold and protect the bitcoin make scammers no collect your hard work from your hands

As this steps Dey simple so, na so is easy to start you ten years bitcoin investment plan and you will thank the day you decided to start.
Bitcoin don show say em b boss over and over again, anybody wey don hear about bitcoin wey still Dey doubt, dey do himself bad and the person no wan progress. All this things we don hear and still dey hear na to ginger us make we dey buy and hold, make we no dull and plan our finances well.
That no.1 step you drop there dey very important, we need dey very disciplined in handling money if not you go see person dey make plenty financial errors. Some fit godey buy shitcoins instead of investing in bitcoin and holding for long term (like next 10years) dem go just rush go throwaway their money.

My dear, you no go blame everybody sha, no be everybody get the kind opportunity to get knowledge about Bitcoin, some people no even know wetin eh be or how they wan start, some no even sabi operate modern facilities,  talk more of to sabi use the Internet, people wey dey really do themselves bad thing na the ones wey done hear come get idea of wetin eh be but still dey procrastinate about am.

 Make we sha ThankGod say we get the opportunity to know, learn come understand wetin Bitcoin dey all about and how we fit take benefits from am cause no be everybody get the privilege, Bitcoin carry plenty opportunities follow body and anybody wey no fit assess the opportunities go really miss a lot.