I hail una my very own people. I know say private keys/seed phrase security no be new gist any longer for this space, but I decide make I revisit this matter because of one conversation wey I get with one padi of mine. Him talk say:
"Him dey plan secure better hardware wallet, and once he gets this done, Him no need worry about losing his funds ever again.”
E dey true sha say hardware wallet dey give better protection for your private keys pass any kind exchange or mobile wallet, but the main koko be say na your seed phrase be the real backbone of your funds, not even the wallet itself.
Make I break am down wella as e dey be, so our newbies go fit follow through
- Your hardware wallet fit spoil due to dust or whatnot or make thief even carry am. And for those wey dey rely on mobile or desktop wallet, your phone fit drop for water, laptop fit even crash, but if your seed phrase dey kampe, you go fit restore your wallet and claim your coins anytime and anywhere.
- And for those wey dey use CEX for long term storage, know this say Dem dem fit freeze your account or hacker fit attack am. If you later move your coins from CEX enter any of your self custody wallet, na the seed phrase fit give you full control over am( in cases where you go looseguard ur private key).
My Final Words for this tori be say wallet apps fit stop work or even vanish from play/app store, hardware wallet fit old or spoil da one sef dey, but ur seed phrase wey be the master- key go still remain valid as long as blockchain still dey alive. Seedphrase dey function just like land document, so as far as e dey intact, your property(coins) dey secured.