Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Know Your Right
by
Sticky Bomb
on 29/07/2025, 16:27:09 UTC
Some people know their fundamental human rights but for this country, if you no get better connections, nah to just give them the money to avoid wahala because e get as e go be, if beta money no dey hand, how you wan handle a court case? So I just believe say, like you talk, e good to know your rights but at the same time, these agencies suppose collect strict warning to no dey use their position dey bully citizens.
Another thing wey I go like add to this talk be say to know your right depend on where you and these force men take get encounter ooo. If you look around and the place dey very lonely and no houses or much people around, e better say you just find them small thing save your life. I don get encounter with Police men wey dem tell me say Oga look around you, you see anybody wey go save you here? If you stress us we go just kpai you here, push you enter that valley and nobody go know say anything happen to you. Omo as I turn round see say sem no lie, I stop to shout begin negotiate, last last na only #5k I give them in exchange for their would have kpai me. I no dey wrong that day, I just saved my life.