Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The Optimum Usefulness of Bitcoin in Nigeria
by
SatoPrincess
on 04/08/2025, 05:55:46 UTC
Quote
pay a bride price
Lol I don't know if this part is meant as a joke.
Why u nor just tell the girl papa say u b yahoo boy.


Lols, No be joke o bross, E actually dy possible na if the pops na man wy sabi. Just imagine say your own son inlaw say e wn give you like 3 BTC as bride price, shay you no go take am ni??


How much is bride price way person go come dey pay for bitcoin…3 btc ke. I know say every culture get their own tradition but I never hear say dowry reach 500k before. For my side, the Urhobo people dey accept as small as 200 naira for bride bride them go still give you back 100 naira say them no dey sell their daughter. So this idea of using bitcoin to pay dowry dey funny to me because the act of using cash to pay is a part of the culture. If e go happen e go first start from people paying dowry with bank transfer before e go advance to crypto.