Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 8 from 5 users
Topic OP
Difference between keeping seed phrase, private and secret.
by
Coin_info
on 05/08/2025, 14:34:46 UTC
⭐ Merited by SmartGold01 (2) ,Africolo (2) ,CryptopreneurBrainboss (2) ,Hatchy (1) ,Mia Chloe (1)
These two words are often used when someone is advising you about securing your bitcoin investment, but thinking about it, he context may be misunderstood clearly by people in different situations who nor really understand well.

I go use the two word for sentence, so we go fit understand am wella, and na-

- Keep your seed phrase private.
- keep your seed phrase secret.

Me I understand say the purpose of the two statements mean the same thing, but for different people the actual meaning dey different. Make I explain.

If you have a trusted partner, wife or husband wey two of una dey on the same motion, keeping your seed phrase a secret, fit affect una marriage unto say e go be like you nor trust them enough, so in that case, the better word na to say make dem keep am private not secret.

If you dey single or you dey with partner wey dun show signs of being unworthy of trust, in that case na for you to keep your seed phrase Secret not private.

Something wey dey private, dey among a group or a few persons, something wey dey secret na something wey you dey keep to yourself alone.

I know say nor be english class be this, but e go make sense say we show a higher level of understanding as crypto enthusiast by using the proper terms when speaking among ourselves and to likely investors we hope to lure.