Baba the story confuse me. You mean say scammers or hackers fit access POS though receipts? If this one na true na him bi say them go don hack almost all the PoS for Naija. Receipt na wetin almost all POS operators dey issue to almost all customers.
I believe say your friend no talk the story well. Maybe the guy man see the password or him press something for the machine. Anyway, we need to dey careful because scammers no dey sleep, them dey bring no pattern almost everyday.
I follow confuse for the story and bin dey wait for something more related to wetin or how these scammers dey operate but no find any. That means wetin Op dey try talk nah say make POS operators no issue out receipts again? Maybe the story need to dey clear for us to fit dey careful and learn something.
No be news say these POS operators dey hear am well from these scammers their hand and nah just to dey very careful so that one no go fall victim but this one wey Op mention nah really "new trick" wey no clear.