Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Naija doing well in cryptocurrency
by
Mpamaegbu
on 07/08/2025, 18:45:16 UTC
For many years now Nigeria don emerge as one of the global leader for adoption of crypto, which Nigerians don use ham tackle so many economic related issues wah dy we country...
If u talk of sey awa people dey plenty wey dey trade cryptos and invest put inside am, I go agree wit u there. But if u talk sey we don use am solve any problem or dey lead for adoption, I go sey dat wan nor work. We dey far from crypto adoption for Naija well well.

If for nothing, I have noticed that, bitcoin and the internet in general has limited a whole of crimes and cultism in the country as compared to previous times and...
Shey u fit give us statistics wit dat so? I nor wan tie cryptos to crime rate but if we dey compare d rate of crime wey we get now and before, e dey obvious sey crime high now pass before. D level of insecurity and criminality dey very scary now oh.

Quote
I might not have been or spent so much time in the crypto space but one thing I can tell is that, bitcoin and cryptocurrency at large has really helped a lot of Nigerian who believed in it...
Dat na pure fact. No argument.