For many years now Nigeria don emerge as one of the global leader for adoption of crypto, which Nigerians don use ham tackle so many economic related issues wah dy we country, e for really good say our government com creates ways wah person go fit dy use crypto dy buy things for places like supermarket,malls,and even to pay school fees, e for really make sense with d wah individuals for we country don get knowledge about this crypto how ona see ham naw
Make I no lie give you crypto don really help people for dis country, most of our youths now, na crypto dem Dey use guide, rate of unemployment Dey increase anyhow for dis country, if you graduate from school now, jobs no Dey before you go fit get work for dis country, na by better connection, and people wey Dey do private sectors Dey work, if you see d kind useless pay wey dem Dey pay dem, money wey be say if dem commot transportation alone, Wetin go remain no go fit do anything again.
I sabi plenty people wey don graduate, and na crypto Dey really help them for dis country, if no be for crypto for naija now, crime rate for even plenty pass like dis, because plenty youths now na crypto Dey help them, if to say e no Dey, even some of dem wey no wan do crime will end up doing it, because hunger no be ur mate.