Post
Topic
Board Off-topic (Naija)
Re: Where This Generation Dey Head Go
by
mid9tclaw02
on 09/08/2025, 09:29:47 UTC
Omo, where this country dey go like this? E be like say Nigeria don dey head one kind direction wey no clear. This our young generation no get patience at all again. Na just yesterday internet begin scatter with news say one SS1 student buy Mercedes Benz and I decided say make i share to this place. Him papa tell am make e return the car, but guess wetin happen? Him own friends dey advise am make e no listen to him papa. Imagine that kain thing!

Na from there person go know say bad friends fit destroy person life. Instead make dem support the papa, dem dey encourage the boy to go against him own father.

Make we reason am weller where SS1 boy wan see money take buy Benz if no be Yahoo or some kind illegal move? Small pikin wey never even finish secondary school don dey do pass him level. Now small children don dey ask for “update” up and down and we all sabi wetin that “update” mean.

The matter really weak me. Things don spoil reach this level. We gats be very careful with the kind people we dey call our friends. If we no watch who we move with, we go just use our hand enter serious gbege wey fit destroy our future.

Make una watch the video too https://x.com/yabaleftonline/status/1942486896522792968?s=46
paddy man the rate at which this yahoo thing don dy go now for we country tire me no body wan do the right thing everybody dy find quick rabbas so e get as e be oh reason ham now ss1 boy dy sjow off benz check out