If bitcoin happens to reach $600,000 , I know say many person go rush sell there bitcoin. But e get people wey go sell all there coins without looking back morespecially those that have been holding for more than 10yrs and whales . Then go like take profits because this amount could be life changing some people fit decide to sell a fraction to meet up with there daily needs and hold the remaining one.
However, those people wey be strong long term holders may not even sell a fraction of there holding. If bitcoin don reach this level, e go dey accepted as a strong store of value globally and some holders fit just want hold and pass there bitcoin to there children in form of generational wealth instead of then converting it to money.
The question I want asked be say at $600,000 dollars will you see bitcoin as it has reached it's peak or still on its way to it's peak
Na normal thing wey suppose happen even if na you wey e dey your side you must cashout, make I use that word "Must" because we get Naija people wey no dey like carry last at all and we like to make profit more than to wait till God knows when. Use for instance when Bitcoin price run go reach $100k many people all over the world wey dey hold and getting ready to cash out really sell well well, the set of persons wey still hold till now wey we dey talk about this your thread no too plenty I think but e still good to hold till now becos something big fit happen again na just patience nai we all need for the crypto space.
All these people wey dey hold as e be long term holders I dey wonder when be the right time to release their holding as in to sell, becos I no know the kind mind some persons get, like wetin be their target? If na Naija person no body go tell them to sell becos many dey wey no go mind to sell and refill again becos this Bitcoin matter be like journey wey no dey end as long as we get life, we continue again.
Support PIGIN For Our Local Board...