If person dey desperate to learn something, e go learn am with one mind and nothing go stop am from thinking otherwise as him dey learn the thing. E go dey more focus and fit even learn faster based on say him mind don make up for that thing. When person come to you to teach am something, e don already show say this person don dey serious about am and go do well to get the best knowledge. If you dey position to fit teach people about bitcoin, e better make you just tell them about am, but no really sugarcoat or wan I try persuade them. If them like am, dem go definitely come for am no matter what. Bitcoin na very delicate kind of investment wey you need to dey very careful about and try to make everybody make their decision about am before dem venture into am.
No be lie, person wey Dey well determined to learn nai be the best to lecture for trading, okay for example, one of my friend wey get the wrong update then land himself for trading without proper knowledge na so he lost everything, so when he come relate am to me nai I ask am who tutor am? He tell me say na he guy but the guy no lecture am well
So I come advise am to go pay for better lecture he come accept
So wetin I dey try to talk be say, with that kind person wey Dey determine to learn then he carry himself to get better knowledge he go calm down learn wella without stress.