If bitcoin happens to reach $600,000 , I know say many person go rush sell there bitcoin. But e get people wey go sell all there coins without looking back morespecially those that have been holding for more than 10yrs and whales . Then go like take profits because this amount could be life changing some people fit decide to sell a fraction to meet up with there daily needs and hold the remaining one.
However, those people wey be strong long term holders may not even sell a fraction of there holding. If bitcoin don reach this level, e go dey accepted as a strong store of value globally and some holders fit just want hold and pass there bitcoin to there children in form of generational wealth instead of then converting it to money.
The question I want asked be say at $600,000 dollars will you see bitcoin as it has reached it's peak or still on its way to it's peak
I will still see Bitcoin as still on his way to his peak.
If your bottom belle come over sweet you for $600 and you come sell of all your bitcoin because you think sey you don make plenty profit, wetin you go come do wen e go reach $1000 or even pass, that time you go come dey regret sey had I know.
Real investors for Bitcoin no dey shake because of the price instead dem go dey buy more, because dem know sey tomorrow dey always beta pass today, you know see the history of bitcoin, so na wetin go make you feel sey your profit don too much make you sell all or some instead to dey happy sey you dey make more money, remember sey the more the days go by the more the profit, abi you no go like get more money or na fear you dey fear sey bitcoin go crash make you no loss all your money wey you don invest all these years.
I believe sey person wey go sell part of him investment that time na person wey really dey in need of money wey no get another choice to get money for any place wey him go take solve him pressing problem, or person wey don reach him overaccumulation stage wey dey reason to diversify into another business so that him go take support to dey buy bitcoin well well has him want am.