Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Naija doing well in cryptocurrency
by
iBaba
on 14/08/2025, 17:35:52 UTC
For many years now Nigeria don emerge as one of the global leader for adoption of crypto, which Nigerians don use ham tackle so many economic related issues wah dy we country, e for really good say our government com creates ways wah person go fit dy use crypto dy buy things for places like supermarket,malls,and even to pay school fees, e for really make sense with d wah individuals for we country don get knowledge about this crypto how ona see ham naw
well many people dey accept bitcoin or any other crypto for transaction, just that e no dey rampart. but i believe with time people go begin use am rapidly. just the temporary ban wey dem place for bitcoin naim come make bitcoin no dey wildly accepted and used for our country naija, but if them lift the temporary ban placed by CBN, many people go used am for many transaction.

Na Naija government they complicate things oo. Them no trust themselves and na why them no wan allow make cryptocurrency flow for the country. I been they think say as Asiwaju Bola Ahmed Tinubu assume office this cryptocurrency especially bitcoin matter go climb him table for more favorable response and approval. I no know say e no go be any strong matter of discourse. 

I believe say plenty Naija people don already Sabi wetin bitcoin means and the very basic knowledge about it, only that a few of these large sum get the opportunity to practically use it for their own personal transactions. If  to say government take am serious, plenty people for don learn am beyond just the name and them for don they maximize the opportunities wey follow bitcoin come like trading and investments.