This scam don tay. I don see am taya na because you never too tay for the crypto space if not you for don see am everywhere for social media. This money sef small, some dem go put 5000usd say make you help them withdraw am. Na mugu dey fall for their trap lol nothing is free not even in Freetown.
No be only mugu dey fall for this type of scam, even the very smart people dey fall for this type of scam, because they are greedy. E get as greed go hold you ehh you go comot all your sensible reasoning and what you go dey see be that money wey you fit get.
E dey pain and embarrassing when you fall for obvious scam just because of greed.
omo wetting you talk na true, when i go online go make research about am, just as sotoprincess talk say say some dey reach $5k dolls i even see say some dey reach $10 to $15k dolls, and that kind money fit tempt person to go try weather you fit move am, from there you go dey tempted to to send gas fee make you move am out of greediness and you go come fall prey. i tell am to put tron for gas fee him start to dey complain say him no no how to do am bla bla bla, to my surprise yesterday i receive notification from okx say dem don deposit Tron, as i try to swap that usdt to Tron them talk say
"this TRON account doesn't have the owner permission required to complete this transaction" meaning say even if i been put that TRON i for no fit swap am. omo logic dey oo.