Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 2 users
Re: Watin inspired you to join the bitcoin forum?
by
HajiBagi
on 18/08/2025, 05:17:42 UTC
⭐ Merited by igebotz (1) ,Localhostspeed (1)
Everybody with there respective reasons of joining the forums, but I know bitcoin forum has make it easier for bitcoin lovers to meet together and share together their different views and ideas about bitcoin related issues,

But i know say all of us get our unique reasons of joining the forum, pls let the conversation flow, thank

This kind question go make person even calm down first but for me na Bitcoin and hustling make me join this forum and na my broda give me the morale to join this forum because I Dey very serious say I want learn about Bitcoin, everybody get different reason wey carry them come this forum but the most important of them na two be the main reasons, the first one na hustling and the second one na because of Bitcoin knowledge carry them come, waiting this forum don do for us no be waiting mouth fit talk instead na to Dey appreciate with how far we have been here, it is not easy to join here from newbie make people dey guide you and understand, no be small thing and the key and motivation to the newbies wey dey join be say make them no give up no matter what.