Hello my naija family and friends in this great forum, please and please my brothers and sisters those of una wey they do POS work, abeg make una de very cautious because wetin i hear today fear me well well.
Na one stranger come to my friend POS shop, say him need airtime, so him no con get the airtime, then the guy tell am say if possible make him send am through his pos then him say okay, him charge am 100naira for each airtime he bought of 1thousand on his two Sims, then the stranger requested for receipt, him send am the receipt.
For my friend side him do business, but na business do am, so after 1 to 2 hours him just start to dea receive debit alert of 1k 1k many, till the extent his account started showing -minus 30k and he told me he was having a balance of 74thousand, please make we de extra careful scammers too much them de everywhere.
Thank you All
Omoh, e means say one gat dey careful now oh especially people wey dey run POS business, new strategise everyday but anyways, we dey online dey see wetin dey sub, so we go wise up.
This one strange aswear, but sometimes I dey wonder how dem dey carry get those plenty tricks wey dem dey use, e just show how crime rate in the country dey on the increase.
Men no dey rest again to find new methods of scamming people to collect them of their hard earned money.
I pray God deliver innocent people and people that are not too expose to these patterns of scammers like our parents.