Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The best formula when it comes to Bitcoin investment
by
Justbillywitt
on 20/08/2025, 08:39:07 UTC
Knowledge + Security + Patience + Discipline = The real deal ( Bitcoin).

I agree say person need get knowledge and know how to secure their I vestment for Bitcoin but, no be everybody go wan get that patience to hodl am.

I no think say this patience op is talking about is not the patience to hodl for long term. I think the patience him dey talk na just quality wey bitcoiners are supposed to get as person wey dey deal with bitcoin. Because even if you be trader, e get sometimes wey you go buy bitcoin for certain price, and you con dey wait make the price add small before you go con sell am. The price no fit go up as you dey expect, instead e go con dip go down small.

You go need get patience make the price go back up at least to the level wey you buy am or your targeted price for sale before you go sell am. If you no get patience, you go sell am for loss as the price drop from your entry point. Na that patience wey Op dey talk about. Wether you dey hold for long or short term, you need get patience.