Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Let's not wash our dirty linen in public
by
Giwagi56
on 20/08/2025, 16:48:06 UTC
Nice talk my broda, I been get this matter for mind don tey and to be honest I Dey wait for person wey go just burst the matter, some of us no dey defend our country for outsiders front, na corrupt our government corrupt we no support paint our country black, na our government no good but our country still remain one of the best country in the world, for we to get mind Dey paint our country black e mean say we too no be better person and no be good citizens as we call ourselves, no any country wey no get scammer but as our people no fit see small money na e make everywhere blast, we should not allow any body see us finish and be talking negative about us because it will affect us and no any outsiders go wan dey trust us, abeg make we no how to talk, everybody dey suffer but make we dey reason before we talk.