Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Food Consumed Half of a Man's Savings
by
Stable090
on 21/08/2025, 20:45:34 UTC
I practically examined myself of my expenses and I discovered that food takes the highest volume of spending which can even affect your savings or empty savings if you're not properly plan. For instance, imagine someone who earn 50k as salary only paint of rice and garri must have the money into two...at the end you'll be wondering what vanished the money. With the current economy situation in Nigeria, 50k is enough for anything sustainable or to encourage good savings habits.

Most people even still displeased themselves of good food, good house and clothes to see if they can save money for the future we're not yet thete.
Omo I no go lie u, na food Dey chop like 70 percent of money wey we Dey earn. Hunger no sabi say u no get money, as long as you are hungry, then you no get choice than make u eat. If you no eat better food, ur body go tell, seriously me I no Dey carry food play, as long as I Dey see better food chop, even if I no get better savings, I no get problem with that. If you wan Dey save, and u no eat better food, then e go still affect you. No be say u no Dey eat unnecessarily, but at least we suppose try Dey eat normal food.

I don seat before just Dey wish say hunger no Dey disturb anybody, if to say  people no Dey eat, person go don achieve better thing for dis life now, because money wey we Dey use eat, person go just Dey divert am go another thing, but we no fit avoid food.