My brother enjoyment money na for enjoyment o, life na one so make I no lie for you, that money wey me keep to take enjoy na strictly for enjoyment. Investment money na for investment and I dey plan am wella as soon as money dey enter my hand. I dey work on a new plan wey be say I go dey invest 20% of every money wey enter my hand, after I don do that one, then I fit dey spend from wetin remain after I don settle every every wey be bill and also keep small as back up.