Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 5 from 1 user
Re: Info-thread: Translation of Useful English topics to Pidgin {mix images}
by
Yeesha
on 23/08/2025, 20:33:32 UTC
⭐ Merited by joker_josue (5)
Translated Topic in Pidgin Language; PrivateTalk – Encrypted & Self-Destructing Messages [100% Privacy | Open-Source]
Original Topic: PrivateTalk – Encrypted & Self-Destructing Messages [100% Privacy | Open-Source]
Author:    joker_josue


 PrivateTalk - Encrypted & Self-Destructing Messages 
   [[100% Privacy | Encrypted | No database | No tracking | Open-Source]]
                                          [ Official Website ] | [ Official GitHub ]


I dey very glad to inform una about Private Talk, e bi open source project wey dey make for people 2 dey use am send message secretly between d person wey send am nd d person wey go receive am, and e go delete d message after dey read am, u no need to register am oooo, nd e still dey secure becos e dey secrets well well.

After, I don observe plenty projects wey dey create for people 2 dey snd message and d e go fit delete d message after dey read am, I con see say those people no dey bother about privacy. I con say, okay make I develop this project.

D community wey create dis Private Talk dey value anonymity, protection and make am easy for people. As I dey talk to you now, e dey available nd na free of charge 2 everybody. Secret massages wey dem encrypt 4 browser  and e go delete himself after dey read am, u no need to register am, e no dey use cookies, e no dey hide logs, e no dey track IP, e no get any place where e go dey store data.

 Wettin b d meaning of PrivateTalk? 
  • PrivateTalk na tool or device wey dem dey use to snd secret messages wey encrypt himself for browser.
  • D message go delete himself after dey read am, or after d time wey d person wey dey use am set.
  • U no need to register am ooo, e no dey store your personal information, nd e no dey use cookies.
  • D code na open-source nd anybody fit go through am.


 Features 
  • Dem go encrypt ur messages for browser like secret code (AES-GCM)
  • E get single or split link 4 maximum privacy.
  • U get choice and chance, if you wan add another password 4 more security or protection, u re free to do am.
  • U fit set a time when d messages go expire or delete, and also d specific time when the message go appear. (“scheduled message”)
  • E get public logs wey go show when d messages destroy/expire (mathematical proof).
  • E get local dashboard where u go fit manage your messages (so u need 2 send anytin to server)


 New in v2.0.0 — Identity (ECC) 
As I dey talk to u now, PrivateTalk get identity (ECC) module, wey dey keep massages safe, using asymmetric encryption (P-256).
U fit generate public key (PTPUB1) wey u go share nd a private key (PTPRIV1) 2 dey keep secret. Na only u go fit read the messages wey dey sent 4 u, for ur public key - nd d messages are deleted and destroyed after you read am.


 Wettin b d tins wey PrivateTalk dey do differently? 
e dey 100% secure 4 keeping secrets:e dey encrypt messages for browser like secret code through AES-GCM, dem no dey send any messages or key 2 d server in clear text. Even d administrator no fit access d content, even if e get full access 2 d server.
Privnote: no dey encrypt 4 browser; d text goes to d server in clear text (dem talk say "nobody dey read am" so, d only tin now na to trust d operator).
One-Time Secret: dey do encryption, but sometimes, d key dey dey for d server nd d security depend on how dem dey implement am.
BurnNote/QuickForget: generally e no dey do client-side encryption; e bi like say na "delete after read" approach dem dey make use of.

Self-destruction and public logs:After dey don read am finish, d message go delete automatically and e no go fit reverse again. D system dey generate special SHA-256 hash 4 each message, wey dey publish logs wey go dey show say dem don destroy or delete/ expire -- anybody fit check am nd dey go know say d file don delete, but no one fit bring am back.
Others: Most of dem no dey show public logs or proof to show say something delete. So, u no go fit know wettin dem delete for there.
Advanced sharing:E get d power 2 divide d secure link into two parts so dat e go get big privacy -- u fit share d link nd key for different channels, e dey increase privacy wen u dey use multiple channels.
Others: Dey go provide only link, dem no dey suggest whether dey should separate d shard/key.
Time-lock and custom expiration:E go allow you to set timer on a specific dates/times wen you go dey read the message (e.g only after 8pm and until 10pm), on top of dat of traditional automatic expiration.
Privnote/One-Time Secret: upon all, d only tin wey e dey support na d expiration after dey don read am finish or after d time wey dem fixed don reach.
Database no dey, tracking no dey, cookies no dey:Everything works with just flat files on the server. Dey no dey track, dey no dey do analysis, zero external scripts. Dey no even get d tools wey dem dey use 4 analysis.
Privnote: E dey use databases, e fit log accesses, normally e dey get cookies nd e dey also get analytics scripts.
Others: dey get ads wey u go fit use to track user's browsing.

Private Dashboard:dey allow d user to dey monitor d status of their messages, wen dem dey (read, active, expired) locally nd manually, nd dey no need to send sensitive information 2 d third party (dey no need 2 bring another person into the picture). E dey completely private, without any automatic communication 2 d server.
Others: no dey allow d user 2 manage d state of d messages -- na only server dey control am.
Simple and auditable code:all is focus na on transparency, easy auditing, nd how dem go dey increase d security 4 end users. Na Open-Source e bi, nd u go fit follow am easily, e no get any obscure dependencies.
Others: dey no bi open source, nd dey no have code dat dey very complex/ difficult to audit.
No registrations, emails, SMS or Telegram:E no dey collect email, phone or other user's information, so dey no get dat kind of notifications -- e dey maintain more privacy nd less tracking.
Others: users go do registration, dem go put their email, put their phone number or other information where dem go receive notifications, Wey go make dem link am with other tins.
 


 FAQ 
How e dey take work?
   U go to the type d message, d browser go generate d link wey u go use 4 encryption, nd na only d people wey get the link/key go fit read am. Wen dey read am finished or e expired nd deleted, nobody go fit bring back the message.
Does the server see the messages?
   No. D text no dey leave ur in a readable format. How does d Dashboard dey take work?
   After u don create d message finish, you fit save am 4 ur computer with d link nd a tag(link,tag) - one line 4 each line. 4 d Dashboard, u fit load d file 4 d browser nd e go analyzes d logs 2 check d status of d message. Na 4 browser u go check am, dey no dey ever send any files 2 d server.

 If u get any feedback, suggestions, or questions, space dey for u, so feel free to talk nd you are free to ask! 
Test am nd leave ur comment or contribute/ share d ideas/bugs wey u get here in d topic (or 4 GitHub). If you like d project nd and u wan support (or buy beer 4 me), i dey accept donations: bc1q9f2dhfdrzruyecfwea3n6nt2nuaj6htzgke5q2




Quote
Dey don add dis project 4 Talk2Tag project, where dem go dey give useful tools 4 forum users. I go give una more information soon.