And again this education we dey run up and down na still money we go still put inside to get to where some of these big people dey, nobody ready to spend plenty at the end wetin we think say we go get no go dey possible na why many of we youths no plan to even go forward about school matter and some choose yahoo because the returns no be joke, abeg no be say I support am but na so e be. As long as government no make education free for us na we dey pay them to dey educated, nai make youth chose yahoo instead of learning hand work as means to survive which e dey pay very well I mean the Yahoo to those wey get sense for the business and them no fit reason to learn work since e dey pay, so make we just dey see things the way e be, no be by force to things again.
Nah the Koko be that. I no dey against education and schooling oh because you go agree with me say the money wey people bin spend for 2000, no go be the same thing with now and so people go need to know say where beta funding no fit dey to do the school, nah to push the money go learn trade so that you fit master am and become a boss of your own when e start to pay.
And again, you know say people dey wey dey fear to go school becos of the way the spendings dey, person go enter school spend money finish come out from school but at the end of the day you go still need to spend to get job or even to further d education like the masters and the rest of them. If say some of our parents see the future con know how rough e go be about to go school eh, them for carry that money take find one better business wey go bring better money in return take push their children put instead of to spend am for school wey the country no really support. Now I no blame people wey stand with this saying say "school na scam".