Even if people use bitcoin as their retirement fund na still one of the best decision be that because bitcoin in just how many year back don move with a significant increase, so just imagine person wey put em money for there dey hope for am to increase and the example wey op give na person wey dey em 70s. That kind person no get much problem again besides if em plan well at that age na em children don supposed to dey support am while if em make that bitcoin investment move so, na added advantage to am but most people at that age for this country dey see all this digital things as scam, they prefer to keep their money for bank wey dem go fit access easily.