My friend, you are right in your opinion. l wish to let you know that crime and corruption did not start from Nigeria, even in the developed countries there use to be story of crime and corruption. What are my saying every country have there own national challenges that they are striving to combat, why should we expose our own problems or challenges to people of other countries who can not even solve our national challenges.discussions like this is supposed to be indoor (among Nigerians), and not with people who are not part of us.
Not neccessarily indoors my dear, make this kind discussions no come here atol atol. We dey use our own hand dey give ourself bad name for this forum with the kind things wey we dey talk for this forum. I just wish say our people go learn something make my worst fears no happen. Make dem no come blacklist Naija people because of the kind nonsense wey we dey talk here. E no hard for oyibo people to do. Me I sure say na because of this nonsense life by some of us nai make some Nigerians for here no gree identify with the Nigerian local board. Dem just wan be on the safer side. Me sef no too blame them, some of us no get better orientation and we dey use our own spoil another person own.