Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: An Opportunity for Bitcoin P2P Usage
by
Bright0515
on 27/08/2025, 13:27:46 UTC
You go try add link to this news make I read through am well well, cuz this news broadcaster sometimes them they sabi spread watin no be am.. and secondly it’s crazy 800,000k per annual that’s them they also consider person way they earn as low as the minimum wage go remit 25% of watin never do them and the family to government way they suffer them say say nah serving..
Watin the op dey talk nah true broda, because even yesterday self I talk this same thing for one comment wey I make say from next year January 1st all Nigerians way dey earn above 800k per year go dey pay tax.
this nah watin I talk about this paying of tax thing I see this news since but I no too take am serious until I make more research.
The government won hold the whole country down make no sectors escape this tax payment. One of the reasons why I like the no too think am nah because of we keep paying taxes and the government is not doing anything good with the tax we are paying to them we can actually speak up maybe even sue them to court. The taxes we pay can be used to make roads and to provide more securities in the country. But we all know our country Nigeria, we fit no know we're the money they enter just the way we no know were the money EFCC dey seize dey enter.