Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: An Opportunity for Bitcoin P2P Usage
by
CryptopreneurBrainboss
on 28/08/2025, 05:54:49 UTC
People wey dey use bitcoin fit dey do deal without them to use naira or bank account, so the real nature of bitcoin wey Satoshi do fit dey in use wella wella for Naija, and that 25% tax no go come affect use wey dey use bitcoin if we come chose to dey use P2P for Naija.

Normally eh, you dey see discussion wey involve avoiding paying taxes no suppose dey encourage for here but the way the government dey behave they make us welcome am. If to say the government dey really use the money wey them dey get from tax payers to improve the standards of the country then I no go dey against am but this one wey be say after you do good citizen finish, na for backyard them go gather share the money between themselves so now what's the need of paying all this taxes. If the taxes dey favour you then why not, continue paying and don't think about bypassing it.