All these meetups no the get head for this our country as a result of the intention the coordinator s and hosts the use organise am. It's not like what we see on other countries abroad where discussions are thoroughly held, questions are tackled deeply to make sure the purpose of the gathering way better to enlighten people is achieved and no be to go use me as to use raise funds to themselves say na bitcoin meetup.
But make we reason am well. Bitcoin itself no need meetup. Bitcoin no get PR manager, no get central office, even the founder we no sabi in real life. Yet the system dey run 24/7 without wahala. Na human beings dey need orientation, no be Bitcoin. And that’s why meetups fit get sense if dem do am well because we Nigerians sabi learn faster when gist dey face2face, no be everybody get time to dig deep online.
So to me, the question no be if meetup dea necessary or not the real issue na who dey hold the mic dea tell people waitin Bitcoin really be. If na one empty hypeman wey no understand Bitcoin, everybody go commot with wrong mindset. But if na solid education dey happen, e fit save plenty people from scam, bad investment.