Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: NEED TO USE MORE PIGIN IN NAIJA LOCAL BOARD
by
Tonimez
on 01/09/2025, 19:00:02 UTC
I don go through many post wey people dey make for this our Local board and I come dey notice say we no dey too use Pigin English well well for this our forum and I think say enfor better make we try dey do more post for here with pigin English as na im be our identity as local board.

I just say make I go through our history and know as oyibo take gree say they go give us local board and I come see say our great men really work hard before oyibo gree give us local board and I even see say e take more than 3 years before our legends @Mpamaegbu, @Charles Tim, @CryptoprenuerBrainboss, @Igebotz and many others fit succeed to get a local board for us from 08/02/2019 to 21/12/2022.

Edited
D request was still not granted, dis wan na becos Dem say d local boardthread speack more of English pass pidgin and also d activity from d local thread still no reach to tay open Dem own local board. Some oga Dem con advice say make we people Dem try keep d board more active and if d statistics show more activities maybe den admin go reason d request.

Na why e go good make we dey appreciate their efforts because e no easy to pursue our local board for over 3 years and succeed. If we go try dey use more pigin for here, e go help to make our talk come down to our own understanding. If you go check the history of our local board you go see say theymos even complain about am say they no get enough post for Pigin because English na general language na.

Make we dey try our best, I know say many people here go school well well and many fit be professors, but make we no forget our root. As a Nigerian, na Pigin be our street identity because they no dey blow grammar for street.

I think the reason why the request was denied in the past is because all of the Nigerians On Bitcointalk speak English and admins probably didn't think a Pidgin English board would have many users. But if the number of Nigerians is much higher now, it makes sense that you guys have your own local. However, if your local would allow users to write in English as well, the admins might turn down the idea. A Pidgin English only local would have better chances.

see advise wey this oyibo even gives during the period. E go good make we keep to it and try to dey post more with Pigin so that we go dey even identify when a person wey no be Naija dey form Naija with us.