Me personally watin inspire me join this Bitcoin forum na my brother and him friends. Everyday I Dey hear dem talk about bitcoin and post wey dem need to make, how dem get limited time to make post and how them give them merit for quality post. Sometimes I even Dey lost for watin dem Dey talk cos I no really understand how this Bitcoin network work but even as I Dey lost, I go still try to ask them little questions to get little idea.
So one day I say to myself why I no just join this community, atleast I know as newbie without the Bitcoin knowledge e go hard me at first, but because of the people wey surround me I say I go join. I wan write too, I wan make post too, I want make person acknowledge my write up as quality post too even thou e go hard. I wan learn, so with time from the different discussion here I go Dey get idea Dey grow small small. Right from time, I know say I no be good writer ooo, even when I bn Dey school I prefer calculation to anything reading or writing too much but I believe say this platform go help build me in writing, e go also help me Dey creative and build new ideas, make research and also get crypto knowledge cos I know say I Dey slack for this things wey I mention. So I Dey happy to Dey here.